3
Jonah Go Nineveh
1 God kon tell Jonah for di sekond time, 2 “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol my message.” 3 So Jonah obey God kon go Nineveh. (Nineveh na one big town and e go take three days to waka round am!) 4 For di day wen Jonah enter di town, e kon tell di pipol, “Afta forty days, God go distroy Nineveh finish!”
5 Nineveh pipol bilive God message, so dem kon sey make evribody fast and wear sak and evribody, both small and old, do wetin dia leaders tell dem. 6 Wen dia king hear di news, e get up from en throne, remove en fine klot, wear sak kon sidan for ashes. 7 E kon kommand, “For inside dis kingdom, Nineveh, mi and all my ofisas don gri sey: ‘Make nobody or animal, chop or drink anytin. 8 Make evribody and dia animals wear sak kon pray well-well to God, den turn from dia sin go meet am.’ 9 May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!” 10 So wen God si wetin dem dey do: sey dem don really turn kom meet am, E kon shange en mind and E nor ponish dem again, just as E bin won do.