11
Last Wahala: Deat
1 God kon tell Moses, “I go bring di last wahala to take ponish Fero and Egypt pipol and afta dis one, e go free una. E go drive una komot with evritin wey una get. 2 So make yu go tell Israel pipol make dem ask dia neighbour for silva and gold.”
3 (Naw, God don make Egypt pipol love Israel pipol. Even sef Moses kon bi one very big pesin for Egypt and Fero savants and Egypt pipol dey respet am.)
4 Moses sey, “Oga God sey for mid-nite, I go waka pass evriwhere inside Egypt 5 and all di first-born son for Egypt, go die. I go start from Fero first-born wey go take-ova en papa throne, go rish di first-born wey en slave girls wey dey grind korn born and all di first-born among en animals. 6 Strong kry go dey evriwhere for Egypt; pipol neva kry like dat before and dem nor go ever kry like dat again. 7 But for Israel pipol side, peace go dey well-well, even dog nor go bark for anybody or animal, den yu go know sey Oga God don separate Israel pipol from Egypt pipol. 8 All dis yor savants go kom meet and bow for mi sey, ‘Make yu and all di pipol wey dey follow yu komot for here’ and afta dis, I go komot for here too.” With vexnashon, Moses kon waka leave Fero.
9 God kon tell Moses, “Fero nor go gri listin to yu, so dat I go fit do my plenty wonders for Egypt.” 10 So Moses and Aaron do all dis wonders wey Fero si, but God make Fero heart strong, so dat e nor go let Israel pipol komot from Egypt.